We do not host files, we only fetch from random sources. If you want to take down a webpage of yours, submit the reports to dmca.waploaded.com and the page will be removed immediately.

Men Dey Reason - S01 E88

Story 4 years ago

Men Dey Reason - S01 E88

Read Story: SEASON 1 EPISODE 88

“guy i no know how i go do am oh, i no know how i

go get my own 33thousand naira for the business

wey we wan start oh, e be like say i no go follow

una do am oh, I never pay Tupac him necklace

money finish sef, guy i get so many wahala for my

head oh” Man complained as both of us sat under

the Mango tree the next morning.

“guy shebi we go start kponkpon work tomorrow,

tell Madam Ifeoma make she borrow you the 33k

na, say she go dey collect am small small if you dey

work” I suggested. “na true talk oh” Man agreed.

Me that was suggesting, i had not even thought of

how my thirty three thousand naira would come.

“guy make we go see how much them go give us as

our share for that yesterday money” Man

suggested and we walked towards Bigie’s room.

We got there at the nick of the time, when they

had finished sharing the money.

“Flow na your own share be this, na 5k” Tupac

offered me my share.

“Man na ur own be this, na 5k sef” He also offered

Man his share.

I was filled with joy as i counted the money.

Because i did little or nothing to earn it.

“But the problem now be say, how we go share dem

this phone?” Brainbox said.

“na true oh, and if to say Ade dey, we for sell

them” said Bigie.

“ehnnnn Brainbox since na you thief am, you go

take one of the phone, Bigie go take one, Me I go

take one, Man and Flow go share the last one” said

Tupac.

Previous Episode

Men Dey Reason - S01 E87

Next Episode

Men Dey Reason - S01 E89

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes