We do not host files, we only fetch from random sources. If you want to take down a webpage of yours, submit the reports to dmca.waploaded.com and the page will be removed immediately.

Danfo wahala - S01 E07

Story 4 years ago

Danfo wahala - S01 E07

Read Story: SEASON 1 EPISODE 7

When your village people want fall your hand , dem go deaf you till you no go listen to wetin people dey tell you .

So e happen say we dey inside bus and the journey far small . One guy wey siddan for front seat with driver just the tune driver radio as if na only him dey listen to the radio. E come reach when conductor even shout for him make him put the radio for one station and leave am there .

E get one guy wey hang for back of danfo , na so dem dey do for this Lagos shaa. Conductor don tellam to come down that if anything happen to him, e no consan anybody . The guy no gree hear word , him still hang for the back of the bus .

Small time, weather come suddenly change and na so rain start to fall o . E shock everybody sef . As rain start , that guy wey hang for back just dey hit the bus make driver stop bus so that he will come down , rain beat am to stupor . Conductor just dey look am dey laff , driver no even send him sef.

As the guy dey beat the back of the bus, the sound dey disturb me sef coz as I siddan for back dey listen to music and nodding my head like agama lizard wey just fall from tree top I no dey enjoy am coz of the noise wey that guy dey make for back . I just feel like make I go givam slap but I just leavam shaa.

At a point, we come meet small go slow for road , na him the guy jump off from the bus , instead of him to go his way , this guy come for front to insult driver first before going . Chai , people for Lagos dey maad shaa.

Anyways, the rain beat am well, next time him no go hang for back of bus .

Previous Episode

Danfo Wahala - S01 E06

Next Episode

Danfo Wahala - S01 E08

What's your rating?
0
{{ratingsCount}} Votes